Vexed Tech Entrepreneur Turns Bitcoin Hacker, Steals €1M+ from Ex-Colleagues AD
No to midnight meeting for Jigawa News | 12.31.2019 | 20:20 126 No more midnight meeting for young boys and girls for one local goment wey dey Jigawa state, north west Nigeria. Authorities for Kirikasamma Local Goment area don ban meeting between man and woman for night and any pesin wey dem catch go chill for prison. Di local goment council authorities tok say dem dey do dis ban sake of all di plenti single women wey dey cari belle outside marriage for di local goment. Wetin Kano goment go do keke drivers wey carry male and female passengers You no fit see your girlfriend afta 9pm for dis town Di leader of di local goment councillors Sa'idu Marma, during di signing of di law say, fornication and unwanted pregnancies among girls na one of di biggest wahala wey di local goment dey face and dat na why dem need di law. According to di law, any pesin wey dem catch dey meet for night with member of opposite sex go fit ...